Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jonah 1:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Dis tin make di men fear God well-well, so dem offa sakrifice gi-am kon promise to serve am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jonah 1:16
19 Iomraidhean Croise  

Den Jakob promise sey, “If God dey with mi kon guide mi thru dis journey wey I dey do so and E give mi food make I chop with klot to wear


Noah build one altar for Oga God. E kon take some from evry klean animal and bird take offa ofrin for di altar.


So Naaman sey, “Since yu nor gri take anytin, abeg make yu give us two donkey wey wi go use take pak una san go awa land, bikos I nor go ever offa any ofrin give any oda god escept yor God.


No wonder evribody dey fear am and E nor get anytin to do with pipol wey feel sey dem wise.”


Make dem tank am with sakrifice kon sing about di tins wey E do.


I go keep my promise wey I make to God for en pipol present.


So make tanksgivin bi una sakrifice to God, den make una keep di promise wey una make to di Most High.


Wen yu promise God sometin, make yu do am kwik-kwik, bikos E nor get anytin to do with fools. So make yu do wetin yu promise.


I look for Yu for nite, my spirit dey find Yu for morning, bikos wen Yu start to judge di world, den pipol for dis world go know and learn how to bihave well.


God sey, “Una nor suppose fear mi wey bi God? Why una nor dey shake with fear wen una si mi? Na mi make san as boundary for sea and dis san nor go let di sea flow pass where I sey make e flow rish. Di wave fit karry di sea up-and-down, but e nor go fit pass der. Di wave fit make nois, but dem nor go fit pass di boundary.


I dey kommand sey, ‘Make evribody wey dey dis kingdom, fear and respet only Daniel God.’ “E go rule forever, bikos E nor dey die. Dem nor go fit distroy en kingdom and en pawa nor get end.


Wen dem hear wetin e tok, fear kon katch dem well-well, so dem ask am, “Wish kind tin yu do so?” Di men tok like dis, bikos dem know sey e dey run from God, just as e bin tell dem.


So dem kry to God sey, “God wey get pawa, wi beg, make Yu know let us die, bikos of dis man! Make Yu know ponish us sey wi kill dis innocent man, bikos Yu wey bi Oga God, must do wetin Yu wont.”


E bi like mustard seed wey bi di seed wey small pass for di world, wey pesin plant for groun.


Fear katch di pipol for di church and odas wey hear wetin happen.


Di angel ansa, “I go stay, but I nor go chop anytin. Instead, make yu kook and burn am as ofrin give God.” (Manoah tok like dis, bikos e nor know sey na God angel dey with am.)


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan