2 Di time kon rish wen Jew pipol dey do dia feast wey dem dey koll Tabanako Feast.
Wen dem dey do Shelta Feast for Etanim mont (wey bi di sevent mont), all of dem kon gada,
For di temple, Solomon and all Israel pipol kon celebrate Shelta Feast for fourteen days. Many pipol kom from Hamat Road wey far well-well for nort and from Egypt borda for sout.
Dem celebrate Shelta Festival akordin to wetin dey di law and evriday, dem dey offa di sakrifice wey dem suppose offa