Anytime dem sofa una for one town bikos of mi, make una run go anoda town. I tell una true word, una nor go run pass all di town for Israel, before Man Pikin go kom back.
“But wen di farmers si di boy, dem kon tell each oda, ‘Di landlord pikin wey go inherit en papa propaty afta e don die, na-im dey kom so. Make wi kill-am and kollect wetin go bi en own.’
Wen di priest oga dem and di law tishas hear wetin e tok, dem kon dey plan how dem go take kill Jesus, but dem dey fear, bikos di pipol sopraiz for wetin e dey tish dem.
Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.