Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”
Again, e go Kana wey dey Galilee, for where e first turn wota to wine. For Kapanaum, one soja-man wey dey work for di king palis dey der and en pikin wey nor well.
Make evribody respet marriage: una must make sure sey una nor sleep with who nor bi una husband or wife, bikos God go judge pipol wey dey sleep with who dem nor marry and pipol wey don marry, wey dey sleep with oda pipol.