1 “I dey tell una all dis tins, so dat nobody go fit deceive una.
God go bless di pesin wey nor dey vex for mi.”
but di seed nor get rut, bikos di word wey e hear, nor strong for en heart, so wen trobol kom, e nor go fit bear-am.
So dem kon dey vex for am. But Jesus tell dem, “Profet dey get respet for evriwhere, escept for en own village and among en family.”
Many pipol nor go gri follow mi again and dem go dey lie and hate each oda.
I don tell una all dis tins, so dat my joy go dey inside una and una joy go full well-well.
But I tell una all dis tins, so dat wen di time rish, una go remember sey I tell una about dem before. I just dey tell una all dis tins, bikos I dey with una since.
E betta make yu nor chop meat, drink wine or do anytin wey fit spoil yor brodas faith.
so dat una go fit choose wetin betta pass and as una dey do so, una go dey ready for di day wen Christ go kom.
Na-im bi di rock wey dey fall pipol, bikos dem nor fit jump am pass. As dem nor bilive God word, dem bigin fall, bikos na so E plan sey e go bi.