Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




John 11:53 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

53 So from dat day, dem kon dey plan to kill Jesus.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




John 11:53
22 Iomraidhean Croise  

Afta some days, di Jew pipol kon dey plan to kill-am,


Wen di priest oga dem hear dis tin, dem kon vex well-well and won kill di apostles.


Di priest oga dem kon plan to kill Lazarus too,


Den di priest oga dem and Farisee pipol kon koll di kansol memba dem togeda, ask dem, “Wetin wi go do, since dis man dey do plenty mirakles?


Two days before Passova and di Bread wey nor get yist Feast, di priest oga dem and di law tishas kon dey find as dem go take arrest Jesus, make dem for kill-am.


Den di Farisee and Herod pipol kon kwik-kwik go outside go plan how dem go take kill Jesus.


Di priest oga dem and di Sanhedrin kon dey find wetin dem go take whole Jesus, make dem for fit kill-am.


So nobody fit ansa Jesus and from dat day go, nobody try to ask am kweshon again.


From dat time go, Jesus kon dey tell en disciples sey, e go must enter Jerusalem where di eldas, priest oga dem and di law tishas go sofa and kill-am, but for di third day, e go wake-up.


But I ansa, “If I tell yu di trut, yu go kill mi and if I advise yu, yu nor go listin.”


Den di ofisas go meet di king kon tell am, “Dis man must die, bikos wetin e dey tok, nor dey help di pipol; e dey kause pain kon make di sojas and evribody for di town, dey fear.”


Make praiz bi God name naw and forever!


My enemies dey gossip mi. Dem dey plan how dem go take kill mi.


I don hear evritin wey dem dey tok and e dey make mi fear. My enemies gada dey plan how dem go take kill mi.


Di kings for di world gada with rulers kon dey plan against God and di king wey E choose.


So I warn dem, “No nid to dey wait for outside till morning. If una try am again, I go ponish una.” From dat time go, dem nor kon dey kom der for Sabat Day.


From den go, half among my men dey work and half dey guide, dem wear war klot and hold spears, shields and bows. And di leaders really support di pipol


Wen Josef brodas si am dey kom from far and before e rish where dem dey, dem kon plan to kill-am.


But di Farisee pipol kon go plan as dem go take kill Jesus.


Dem kon plan for sekret to arrest Jesus make dem for kill-am.


Afta, Jesus kon travel go evriwhere for Galilee. Den e komot for Judea, bikos di Jew oga dem won kill-am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan