Wen Jesus dey Betany for Simon house (wey get leprosy before), e sidan with dem to chop, naim one woman bring oil inside alabasta box kom, di oil dear well-well and dey send fine. Afta e don open di kontaina, e pour di oil for Jesus head.
Mary take perfume wey dear well-well, wey plenty rish kwota gallon kon pour am for Jesus two leg. Den e use en hair take klean dem. (Di perfume send kon full evriwhere for inside di house).