Awa grand-grand papa dem nor tank Yu for all wetin Yu do for dem for Egypt. Dem kwik forget all di good-good tins wey God do for dem. True-true, dem go against God kommand, afta dem cross di Red Sea.
But doz wey dey opress oda pipol, nor know anytin at-all. Dem bi fools! Dem dey waka anyhow for darkness, while all di foundashon for di eart dey skata.
Many pipol go dey klean; dem go klean dem well-well, but wiked pipol go still dey do dia wikedness. No wiked pesin go undastand naw, but na only wise pipol, go fit undastand.
“Since I dey use parabol tok to una; but di time dey kom wen I nor go use parabol again, but I go tell una about my Papa for di way wey una go undastand.
Na dem bi ezample for dis word wey pipol tok, “Dog dey go back go chop en vomit,” and “Pig wey dem don wosh en body, go still go liedan for portor-portor.”
Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.