Thirty years afta dem karry us go Babilon as slave, wen I dey stay with my pipol near Chebar River, for di fift day for di fourt mont, heaven open and I kon si one vishon.
But make una know sey Man Pikin get pawa for dis world to forgive pipol dia sins.” So e kon tell di man wey nor fit waka, “Stand up, karry yor bed, make yu dey go yor house.”
Jesus ansa am, “Yu really ready to die for mi? Make I tell yu true word, before fawol go do ‘Kukuruku’ dis nite, yu go tok three times sey, yu nor know mi.”
I tell una true word, di pesin wey bilive mi, go do di kind mirakle wey I dey do and e go even do di ones wey big pass dem, bikos I dey go meet my Papa.
I tell yu true word, wen yu dey small, yu dey do as yu like, dey dress as yu like and dey go anywhere wey yu wont, but wen yu go old, yu go spread yor hand and oda pipol go help yu tie yor klot and karry yu go where yu nor won go.”
Naim Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, di Pikin nor fit do anytin with en own mind, escept di tins wey e si en Papa dey do. And na anytin wey e si en Papa dey do, naim e dey do too.
Den Jesus tell dem, “Make I tell una true word, nor bi Moses give una bread from heaven, but God, wey bi my Papa, na-im give una di true bread from heaven.
Wi know sey God ways dey great well-well: Christ kom as human being; di Spirit show sey e dey free; angels si am wen e kom prish among Gentile pipol; pipol bilive am for di world and God karry am go heaven with glory.
Den I si heaven open and one white horse dey kom out! Dem dey koll di Pesin wey dey ride di horse, “Faithfulnes and Trut.” E dey judge without parsha or wayo even as E dey go fight war.
Afta all dis tins, I look up kon si one door wey open for heaven! Den di vois wey I first hear kon tok to mi like loud trumpet sey: “Make yu kom up, so dat I go show yu wetin go happen afta dis tins.”