God sey, “I bin dey ready to help my pipol, but dem nor kom meet mi make I help dem. I bin dey ready make dem look for mi, but dem nor even try. All di nashons nor pray to mi, even doh I dey ready to ansa sey: ‘Na mi bi dis, I go help una.’
As Jesus komot from der, e si one man wey na name bi Matiu, wey sidan for where dem for dey pay tax. Jesus kon tell am, “Follow mi.” At wons, di man kon get up follow am.
Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”
Nor bi sey I don get evritin wey I wont or God don make mi pafet, but I dey try make I get di prize wey dey kom from God kon hold am as Jesus Christ whole mi.