Bikos dem don born one pikin for us! God don give us boy pikin! E go bi awa ruler and dem go koll am, “Wonderful Advise, Mighty God, Everlastin Fada and di Prince wey bring peace.”
But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.
“I dey baptize una with wota make una for turn from sin kom meet God, but di pesin wey go kom afta, strong pass mi. I nor big rish to luz di rope wey dey en shoe, na-im go baptize una with Holy Spirit and fire.
John ansa dem, “Na ordinary wota I take dey baptize una, but di pesin wey big pass mi, dey kom, I nor rish who go luz di rope wey dey en shoe. E go baptize una with di Holy Spirit and fire.
“Make yu rite evritin wey yu dey si inside dis book, den send dem go meet di pipol wey dey di seven church wey dey for Efesus, Smyrna, Pergamum, Tiatira, Sardis, Filadelfia and Laodicea.”
“Make yu rite di tins wey I won tell yu naw, go give di angel for di church wey dey Smyrna: ‘Dis message na from di Pesin wey bi di First and di Last, di One wey die kon kom back to life.