Doz wey bin dey opress una, dia sons go kom bow for una. All di pipol wey look down on una before, go kon woship una. Dem go koll una, ‘Oga God Town. Zion, di town wey Israel God wey dey holy dey stay.’
But naw, doz wey distroy una, dem go distroy dem too and dem go karry all una enemies go Babilon as prisonas. Dem go opress doz wey dey opress una and doz wey tif from una, dem go tif from dem too.
Dia gift wey dem dey bring from Sheba or di incense wey dem bring from far land nor mean anytin to mi. I nor go fit asept dia ofrin again and dia sakrifice nor fit make belle sweet mi.’
Sheba and Dedan pipol with doz for Tarshish go kom meet yu sey dem wont make yu give dem some from di silva and gold, plus di animals and propaty wey yor sojas kollect from Israel land.”
Den Deborah sey, “Okay! I go follow yu go, but nobody go praiz yu for dis war, bikos God don sey na woman go kill Sisera.” So Deborah kon follow Barak go Kedesh.