Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joel 3:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Una sell Judah and Jerusalem pipol give Greek pipol so dat dem go karry dem go far kountry.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joel 3:6
6 Iomraidhean Croise  

Una do business for Greece, Tubal and Meshak kon sell una goods to get slaves and to kollect tins wey dem make with bronze.


Dem trow dice take divide who go take my pipol as slave. Dem sell boys and girls as slave kon use di money take buy wine and karry ashawo.


I go make dem sell una shidren give Judah pipol; dem go sell dem go Sabeans land wey far well-well. Mi, wey bi God, don tok.”


I go use Judah pipol take do bow and Israel pipol go bi my arrow. Zion men go bi my swod wey I go take distroy Greece pipol.”


God go give una shidren to oda pipol and even as una dey look dis tins, una nor go get pawa to do anytin.


Den God go put una for ship kon send una go back to Egypt, to di place wey E promise sey una nor go ever si again. Den for der, una go sell unasef give una enemies as slaves, but nobody go gri buy una.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan