Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joel 3:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Dem trow dice take divide who go take my pipol as slave. Dem sell boys and girls as slave kon use di money take buy wine and karry ashawo.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joel 3:3
8 Iomraidhean Croise  

Yu go gambol for di pipol wey nor get papa again. Bikos of money, yu go sell yor friends wey like yu well-well.


Una do business for Greece, Tubal and Meshak kon sell una goods to get slaves and to kollect tins wey dem make with bronze.


Una wey dey drink anyhow, make una wake-up bigin kry. Una wey dey drink wine, make una kry; bikos dem don distroy di grape and all una sweet wine don finish.


God sey, “Bikos Israel pipol don too sin, I go ponish dem naw. Dem sell innocent pipol bikos of silva kon sell poor pipol, bikos of ordinary shoe.


Wen dia enemies dey attack dem, una stand dey look and nor gri help dem. Strenjas attack and karry all dia propaty kon trow dice take divide Jerusalem, but una bihave like sey Israel na una enemy.


Yet, dem still karry en pipol go as slaves. Dem kill dia shidren for evriwhere for di street. Dem shain and divide Egypt sojas among demsef kon karry dem go as slave.


Cinnamon, spices, incense, pomade wey dey send well, frankincense, wine, olive oil, flower wey dem take dey make bread, melu, sheep, shariot, slaves and human being soul.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan