Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joel 3:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 For dat time, sweet wine go dey pour like rain from di mountins and di hill go flow with milk. Wota go dey evriwhere Judah, but river go from God temple rush go wet Shittim Valley.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joel 3:18
18 Iomraidhean Croise  

My melu and goats dey give mi plenty milk and my olive tree dey grow for groun wey dry and strong.


Di wota from di river dey bring joy kom God town; di special and holy place where di Holy One dey stay.


I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.


For dat time wen dem kill pipol well-well and di towas don fall, wota go dey flow kom from evry mountin and hill.


Pipol wey nor fit waka, go stand up dance and pipol wey nor fit tok, go dey shaut with happiness. River go dey flow kom from all di desert;


I go give una wota for dry land kon make wota flow pass where wota nor dey. I go put my Spirit for una shidren body kon bless una shidren-shidren.


I go send viktory kom from di sky like rain, so make di eart open and receive am; so dat salvashon and korrect judgement, go grow. Mi, wey bi God, go make dis tins happen.”


God sey, “All of una wey wota dey hongry, make una kom drink from dis wota! Una wey nor get money, make una kom chop! Make una kom drink wine and milk and una nor go pay anytin!


Una go enjoy en propaty like pikin wey dey suck en mama breast. Una go drink beleful bikos of all di tins wey e get.”


Bikos of di gift wey God give dem wey bi; korn, wine, olive oil, sheep and melu, dem go gada kom sing with happiness for Mount Zion. Dem go bi like gardin wey dem pour wota put well-well kon get evritin wey dem wont.


My pipol, una nor remember how King Balak for Moab try to curse una, but instead na blessing Beor pikin Balaam, bless una? Make una remember as una travel from Shittim go Gilgal and mi, God do evritin wey I fit do to tish una sey I dey faithful.”


For dat day, na only fresh wota go dey rush kom out from Jerusalem. Half go-go di Dead Sea and di oda half go-go Mediterranean Sea. E go dey rush both for dry and rainin sizin.


Wen Israel pipol dey for Shittim, dem kon dey sleep with Moab wimen.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan