17 “Den, Israel pipol, una go know sey na mi bi di Oga una God. I dey stay for Zion wey bi my holy hill. Jerusalem go bi holy town and strenjas nor go fit win am again.
“I don hear Israel pipol komplain, so go tell dem, ‘Una go chop meat for evening kon chop bread for morning until una beleful, den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God.’ ”
So, great Zion, God hill wey dey holy, no evil or wahala go dey der again. Just as wota dey full sea, na so too God word go full pipol heart for di land.
One fine road go dey der and dem go koll am, “Holiness Road.” No sina go travel pass dat road and foolish pipol nor go fit deceive doz wey dey waka pass der.
Jerusalem pipol, make una dey great and strong again! God holy town, make una wear pride like klot! Pipol wey nor know God nor go enter una gate again.
“I go bring una kom Zion wey bi my holy hill kon give una joy wen una enter my prayer house, den I go asept di sakrifice wey una go offa for my altar. Dem go koll my temple, ‘Prayer house’, for all di nashons.”
Israel God wey dey rule evribody sey, “Wen I don bring di pipol kom back to dia land, dem go tok for Judah sey, ‘Make God bless Jerusalem hill; di holy place wey E dey stay.’
All di valleys wey dem trow dead body and ashes put and all di field go rish Kidron Brook and di Horse Gate for east, go dey holy for God. Nobody go ever skata or distroy di town again.”
All of una for Israel go woship mi for di land wey dey on-top my holy mountin. I go dey good to una, so I espect una to give mi una sakrifice, betta ofrin and gifts wey dey holy.
Mi wey bi God wey get pawa, dey kommand una sey, strenjas wey neva sekonsaiz; doz wey nor dey obey mi, make dem nor ever enter my temple, even if na strenjas wey dey stay with my pipol.”
Before-before, Yu dey defend us. So make Yu nor vex for Jerusalem again, bikos na yor town and holy hill, e bi. Doz wey dey stay near us, dey look Jerusalem kon dey laf yor pipol, bikos of awa sin and di wiked tins wey awa grand-grand papa dem do.
Doz wey dey weak, go survive and doz wey bi slave and prisonas for anoda kountry, go kon bi one strong nashon. Den mi wey bi God go rule Jerusalem as dia king forever.”
Si! One messenja dey from di mountin kom give una good news! E dey bring peace message kom. So my pipol for Judah, make una celebrate kon do wetin una promise, bikos una wiked enemies nor go ever enter una land again and God go distroy dem finish.
And naw, Oga God sey, “I dey go back to Jerusalem kon stay for Zion wey bi my holy town. Den pipol go koll Jerusalem ‘Di town wey dey faithful’ and dem go koll Oga God mountin, ‘Di holy mountin.’ ”
But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.