Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joel 3:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Di pipol must ready kom Jehoshafat Valley. Na for der mi wey bi God go sidan judge all of dem.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joel 3:12
17 Iomraidhean Croise  

For di fourt day, dem gada go Beraca Valley kon praiz God for der. Na Beraca Valley dem dey koll dat place till today.


My God, make Yu vex raiz-up for mi, den kon fight my enemies! Abeg, raiz-up make Yu kom fight for mi!


before God, bikos E dey kom! Yes, E dey kom judge di eart. E go judge di world well-well and E go judge evribody akordin to wetin dem do.


before awa Oga God, bikos E dey kom judge di whole world. E go judge di whole world well kon judge evribody, with raitiousness.


E go judge and setol kworel among nashons. E go setol many pipol kase. Dem go turn dia swod to ordinary blade kon use dia spear dey work for vineyard. Den, no nashon go fight against anoda nashon and dem nor go train pipol to fight war again.


Dis message na about di Vishon Valley: Wetin dey happen? Wetin make evribody dey klimb go on-top roof?


God don dey ready to judge. Yes! E don ready to judge en pipol.


Di day wen God go take akshon, don near. For dat day, darkness and trobol go full di kountry.


God sey, “Wen all dis tins dey happen, I go give Gog one grave for Travelas Valley wey dey di Dead Sea for Israel east. Dem go beri Gog and all en sojas for der and dem go koll am ‘Hamon-Gog Valley.’


Plenty-plenty pipol dey Judgement Valley. For der, God day go soon kom.


I go gada and judge di pipol for Jehoshafat Valley, bikos of wetin dem do my pipol. Dem skata Israel pipol for evriwhere kon divide dia land.


God go judge many pipol kon setol di kworel wey strong nashons get. Den dem go dey use dia swod and spears take dey work for farm. Pipol from difren kountry nor go fight each oda again or train dia pipol to go fight war.


For dat time, E go stand on-top Mount Olives kon face di east side for Jerusalem. Den Mount Olives go divide into two from east go west. Half part for di mountin go-go nort and di remainin part go-go sout.


Den I si heaven open and one white horse dey kom out! Dem dey koll di Pesin wey dey ride di horse, “Faithfulnes and Trut.” E dey judge without parsha or wayo even as E dey go fight war.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan