But dem nor know wetin God dey tink; dem nor undastand en plans. Dis pipol nor know sey God dey gada dem, so dat dem go beat and mash dem pass like korn wey dem mash for groun.
So God sey, “Una must get patient as una dey wait for mi. For di day wen I go attack kon karry all una propaty, I don decide sey, I go gada nashons and kingdoms togeda kon pour my vexnashon on dem. Bikos my vexnashon go full di whole world.