Dem wiked well-well and just as dem dey kut korn for harvest time, na so too I go kut dem trowey kon mash dem, just as dem dey mash grapes until di wine kom out finish.
For dat time, sweet wine go dey pour like rain from di mountins and di hill go flow with milk. Wota go dey evriwhere Judah, but river go from God temple rush go wet Shittim Valley.
God sey, “Di day dey kom wen korn go kwik grow even before harvest time rish and grape go grow kon ripe before dem suppose make wine. Sweet wine go dey rush kom out from di mountins and wine go dey flow for di hills.
“Make una bring one out of evry ten tins wey una get kom my temple, so dat food go dey der. Den make una try mi, weda I nor go open heaven kon pour many-many blessings for una head.