Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joel 2:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 For dat day, darkness go kover di land and kloud go full evriwhere! Strong-strong sojas go kom and dem go bi like darkness wey spread kover di mountins. Dis kind tin neva happen before and sometin like dis nor go ever happen again.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joel 2:2
34 Iomraidhean Croise  

Dem dey tell demsef sey, “No bad tin go ever happen to us! Wi go dey free from trobol forever!”


Dark kloud dey round am. Na to do rite and judge well, bi di foundashon for en throne.


Di lokust kover evriwhere for Egypt, plus di arias wey dey near der. Di wahala strong well-well and dem neva si any lokust like dat before and dem nor go ever si any lokust like dat again.


Di lokust dem go full yor house, yor savants house and all Egypt pipol house and e go plenty pass wetin una papa and grand-grand papa don ever si since wen dem dey di land kon rish today!’ ” Den Moses turn kon waka leave Fero.


Di pipol stay far from di place, but Moses waka near di tick kloud, where God dey.


Wen dat day rish, di sojas wey dey kom from far, go make loud nois give Israel pipol; di nois go sound like wave for sea wey nak rock. Den wen yu look di land, yu go si sey e skata and dey dark, bikos di kloud don turn dia lite to darkness.


Wen dem look groun, dem nor go si anytin escept trobol and darkness wey go make dem fear well-well and e nor go get how dem go take eskape.


Make una respet di Oga una God, before E go bring darkness wey go make una kick stone fall on-top mountins! Make una respet am, before E go turn una lite to darkness.


Afta, God kon sey, “Go back go kollect di short nika for where yu beri and hide am put.”


Una wey dey waka pass, my sofa nor mean anytin to una? Make una look round, una si anybody wey dey sofa like mi? But na God vexnashon dey kause dis pain and sofa for mi.


Wen I don distroy yu, I go kover di sky kon komot di stars. Di sun go hide for di kloud back and di moon nor go shine again.


just as shepad dey kare for dia sheep wey skata kon gada dem again. For dat day wen di wahala go start, I go bring dem kom back from where dem skata go.


Yu, yor sojas and all di many kountries wey dey with yu go attack Israel like betta strong rain and una go bi like kloud wey kover di eart.”


“Den Mikael; di great prince wey dey guide yor pipol, go appear. Dat na wahala time and dis kind wahala neva happen for anywhere kom rish naw. But yor own pipol wey dia name dey di book wey get life, go eskape.


Yu don do wetin Yu sey Yu go do wi and awa leaders. For all di towns wey dey for dis world, na Jerusalem Yu dey ponish pass.


Many sojas from one strong kountry don kom attack awa land. Nobody fit kount dem and dia tit strong and sharp like lion own.


Evry of una tin wey lokusts chop and distroy for doz years, I go give dem back to una, bikos na mi send doz lokust against una.


Di sun go turn to darkness and di moon go turn to blood. All dis tins go happen before di great day wey God don choose, go kom.


Dem go dey make nois like war horse wey dey run on-top mountin and dia nois bi like dry grass wey fire dey burn. Dem bi like strong sojas wey ready to go fight.


Tyre, Sidon and Filistia pipol, wetin una dey do mi? Una dey try to pay mi back for wetin I do? If na so, den I go kwik-kwik attack una!


“Na mi God kreate di mountins and breeze. I allow human being know wetin I dey tink. Na mi dey bring darkness to take kover lite and I dey waka on-top di hill. Na mi bi God and na mi get all di pawa.”


So make una stand for God wey get pawa front, bikos di wonderful day wen God go judge di world, don near. God don prepare to distroy en pipol and E don choose who go kill dem.


For dat day, lite nor go shine again; di place wey dey bring lite from heaven, go stop.


bikos for dat time, di sofa wey go dey, go strong pass any sofa wey don happen since wen God kreate di world kom rish naw and dis kind sofa, nor go dey again.


Bikos wen dis tins go dey happen, di kind sofa wey go dey, neva dey since wen God kreate dis world and dat kind sofa, nor go dey again.


Make una remember as e bi before, make una tink about di generashon wey don pass. Make una ask una papa and una eldas and dem go tell una evritin.


Una don rish Mount Sinai, where God for tok to Israel pipol. For der, fire dey burn, darkness dey der and storm and


Dem bi like wave for sea wey dey foam kom out. Dem bi like star wey nor dey stay one place and God don keep di place wey deep pass for darkness, dey wait dem.


Wen e open am, smoke kom out like fire kon turn di sun and breeze to darkness.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan