God tell Jerusalem pipol, “Oda pipol go build una wall and dia kings go serve una. I bin ponish una, bikos I dey vex, but naw, I go show una my favor and mesi.
Oga God! Make Yu look us from heaven, yor holy place where Yu dey stay wey get glory. Where yor pawa and strong mind dey? Where yor love and mesi dey? Make Yu nor leave us at-all.
So God ansa, “Israel, una bi my shidren wey I love well-well. I dey always tink of una with love wen ever I remember una name. Una dey for my heart and I go really sorry for una.
“Dis na wetin God wey dey lead heaven soja tok: ‘I dey always like to bless Zion, bikos of di strong love wey I get for en pipol and na dis love dey make mi vex for dia enemies.’ ”
Make una tink of how wi dey look pipol wey get patient sey, God don bless dem. Una hear how Job get patient and how God bless am leta. God get mesi and E dey sorry for pesin well-well.