Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joel 2:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Make una gada di pipol; prepare dem for di holy meetin; bring di old pipol, den gada all di shidren too. Even pipol wey just marry must kom out from dia bedroom.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joel 2:16
21 Iomraidhean Croise  

All di men for Judah, dia wifes and shidren kon stand for God front.


kon tell dem, “Una wey bi Levi pipol, make una listin to mi. Make una dey holy, so dat una go fit make una grand-grand papa dem temple holy! Make una remove anytin wey nor dey klean from God Temple!


Many pipol wey gada neva santify demsef, so Levi pipol kill di Passova lamb for all di pipol wey nor dey klean and wey nor fit make holy sakrifice for God.


evribody wey won follow God wey bi en grand-grand papa God, even doh dem nor dey klean as dem rite am for di temple law.”


Make una kill di Passova lamb, dedikate and prepare unasef for una pipol kon do wetin God kommand una thru Moses.”


One dia party finish, Job go koll and santify dem. For early morning, Job go offa sakrifice for all of dem. “Bikos e bilive sey dem fit nor know sey dem don sin and curse God.” Job dey do dis tin evritime.


and e dey shine kom out like man wey just marry. E dey happy like pesin wey dey ready to run race.


God tell Moses, “Make yu use today and tumoro take santify di pipol kon tell dem make dem wosh dia klot


E tell dem, “Make una dey ready for di third day and make di men nor sleep with dia wifes.”


Even di priests wey dey near mi, make yu tell dem make dem wosh demsef well-well, if not I go distroy dem too.”


Koll and tell evribody sey make dem fast! Gada di leaders and all Judah pipol go meet and kry give God for en temple!


So di priest oga dem and di tishas kon ask Jesus, “Yu dey hear wetin dem dey tok?” Jesus ansa dem, “Yes! Una neva read sey, “ ‘Na shidren and small pikin wey dey suck breast go praiz God?’ ”


Jesus ansa, “Pipol wey kom marriage nor fit mourn if di man wey dey marry dey with dem! Abi e dey happen like dat? But di day go kom wen dem go take di man wey dey marry komot from where dem dey, dat time, dem go fast.


Make una nor refuse each oda, escept una gri sey una go dey like dat for sometaim, so dat una go fit pray. Den Satan nor go fit tempt una, bikos una go fit kontrol una body.


“Make yu get up! Go santify di pipol make yu tell dem: ‘Make una santify unasef before tumoro, bikos Israel God sey, “Israel pipol, una body dey dirty! Una nor go fit fight una enemies until una remove wetin make una dirty.”


Joshua read Moses kommand for all Israel pipol front, plus di wimen, shidren and strenjas wey dey stay with dem.


Samuel ansa dem, “Yes! Na peace I bring kom. I won give God sakrifice.” So e santify Jesse and en pikin kon invite dem kom di sakrifice.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan