Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Joel 1:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Make una kry like virgin wey dey mourn for di man wey e suppose marry.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Joel 1:8
13 Iomraidhean Croise  

Dis kind woman nor dey faithful to en husband and e don forget di holy promise wey e make.


For dat time, Oga God wey dey lead heaven sojas kon sey make una dey kry, mourn, shave una hair and wear sak klot.


Una dey enjoy life since and nor kare about anytin, but naw, make una shake dey fear! Make una pul una klot kon tie rag for una waist.


Una even dey kry to mi naw sey, ‘Yu bi awa papa. Na from small pikin Yu love us kom rish naw.


Jerusalem road dey mourn, bikos nobody dey pass der go celebrate again. Di town gate kwayet and pain won kill di priests dem. Di yong wimen dey kry, bikos di trobol wey dem dey face, too mush!


“I go turn una festival to burial kon shange una happiness to kry. I go make una kut una hair kon wear sak klot, den I go make una mourn like sey una only pikin just die. Dat day go bitter well-well.


God nor sey, una and una wife go bi one body and spirit? Wetin make am tok like dat? Na bikos make una for get shidren, wey go bi God pipol. So, make una make sure sey, una nor break di promise wey una make with una wife.


Yu wey get money, make yu listin! Cry make dem hear yor vois, bikos of di bad tins wey go happen to yu.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan