King Ahab tell Obadaya, “Make yu go all di land; pass thru di wota and di valley kon shek weda yu go si any aria wey grass dey, so dat di animals go-go chop for der, make dem nor for die.”
Na how long awa land and di grass for di farm go dey dry? Awa animals and birds dey die, bikos of dis pipol wikedness! Pipol wey sey, ‘God nor dey si wetin wi dey do.’ ”
Amos sey, “God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois for Jerusalem bi like tonda nois. All di trees and grass wey dey Mount Karmel, dry finish.”