Na how long awa land and di grass for di farm go dey dry? Awa animals and birds dey die, bikos of dis pipol wikedness! Pipol wey sey, ‘God nor dey si wetin wi dey do.’ ”
Di happiness and joy wey dey Moab land, don vanish. I don make dia wine stop to flow from di winepress. Nobody dey to make wine for dem and una nor go hear happiness nois from der again.
Una wey dey drink anyhow, make una wake-up bigin kry. Una wey dey drink wine, make una kry; bikos dem don distroy di grape and all una sweet wine don finish.
Yes, I don sey rain nor go fall for una land, hills, farm, vineyard, olive trees and for evritin wey di groun dey produce for una and una animals. I go skata evritin wey una dey work hard to get.”