Wen Abner rish Hebron, Joab take am go di gate side like sey e won tok to am where nobody go hear, den e shuk Abner for belle. Na so e take kill Abner, bikos e kill Asahel wey bi en broda.
Make Yu nor drag mi follow pipol wey dey do wiked; doz wey dey tok like sey dem bi friend to dia neighbour, but dem dey plan bad tins for dem for dia mind.
God sey, “Dis pipol bi like sojas wey don ready dia bows. Dem always dey ready to lie, bikos of dis, dem don get pawa for di land, but na wayo dem take get am. Dem don do many bad tins and dem nor dey tink of mi wey bi dia God.
Make evribody dey kareful of en friends and make yu nor trust yor broda, bikos even broda dey shit en broda. And friends dey lie against each oda well-well.