Dem don kontinue di wiked tins wey dia grand-grand papa dem do before, wey make dem nor obey my kommand. Demsef don dey woship oda gods. Both Israel and Judah pipol don break di kovenant wey I make with dia grand-grand papa.
Before dis time, I bi like lamb wey dem won go kill, even doh I nor know anytin. I nor know sey na mi dem dey plan dis kind wiked tin for. Dem bin sey, “Make wi kut di tree naw wey e still dey fresh; make wi kill-am, so dat nobody go remember am again.”
Dis wiked pipol nor gri obey mi. Dem dey follow dia sturbon and wiked heart kon dey woship and serve oda gods. So dem go bi like dis nika wey nor get value again.
Den di pipol sey, “Make una kom, make wi do sometin about dis Jeremaya! Wi go always get priest wey go dey to tell us wetin wi go do; wise pipol go dey wey go advise us and wi go always get profet wey go prish God word give us. So make wi lie against am kon stop to listin to anytin wey e tok.”
I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”
Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong.
My pipol don die finish bikos dem nor know mi. Since di priests don rijet mi, misef go rijet dem as my priests. Since una don forget una Oga God laws, misef go forget to bless una shidren.
I go test di third part wey survive kon klean dem, just as dem dey klean silva for fire. I go test dem, just as dem dey test gold. Den dem go pray give mi and I go ansa dem. I go tell dem sey dem bi my pipol and dem go sey, ‘Na di Oga bi awa God.’ ”