4 Make evribody dey kareful of en friends and make yu nor trust yor broda, bikos even broda dey shit en broda. And friends dey lie against each oda well-well.
Nor bi di same papa all of us get? Nor bi di same God kreate all of us? Den why wi dey break awa promise wey wi make to each oda kon hate di kovenant wey God make with awa grand-grand papa dem?
Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.