Make una keep di kovenant wey una make with mi wey bi una God kon dedikate unasef to mi. If una nor do am and una kontinue di bad tins wey una dey do, my vexnashon go burn una like fire. E go burn well-well and nobody go fit kwensh am.”
Na Egypt king and en pipol bi di tree. E get any tree for Eden wey tall and fine like una? But naw, like di trees for Eden, una go die kon join wiked pipol and doz wey dem kill for war. Dis na wetin Oga God tok.’ ”
Dem don dirty my temple, bikos dem dey allow pipol wey neva sekonsaiz enter. Pipol wey nor dey obey mi dey enter di temple wen dem dey offa animal give mi as sakrifice. So my pipol don break di kovenant with all dis yeye tins wey dem dey do.
but di really Jew na pesin wey bi Jew for inside en heart, bikos sekonsishon nor dey tosh pesin heart. Na di Holy Spirit dey do dis kind work, nor bi di law wey dem rite down and dat pesin go dey receive praiz from God, even doh human being nor praiz am.
Jonatan kon tell en savant, “Kom make wi go di oda side go meet all dis men wey dem nor sekonsaiz. May bi God fit fight for us. Nor-tin go fit stop God to save us, weda dem many or small.”
David ask di men wey stand near am, “Na wetin dem go do for di man wey go kill dis Filistia man kon free Israel from shame? Bikos who bi dis Filistia man wey nor sekonsaiz, wey dey shalenge God wey dey alive, sojas?”