Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 8:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Just as bird for sky know wen to fly, na so too, dove, swallow and crane know wen to shange pozishon. But my pipol nor gri do wetin mi, wey bi God sey make dem do.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 8:7
10 Iomraidhean Croise  

Di flowers don dey grow and di time wen birds dey sing, don kom and naw, wi dey hear dove dey sing for awa land.


Melu know en owner, donkey sef know who dey gi-am food, but Israel wey bi my pipol nor know or undastand mi at-all.”


Di pipol bi like trees branches wey don dry and skata for groun; wey wimen dey gada take do firewood. So, bikos di pipol nor undastand anytin, God wey kreate dem nor go sorry or pity for dem.


Yes! Una dey play harp, tamborin, flute and dey drink wine for una party, but una nor undastand wetin God dey do,


But God sey, “My pipol foolish well-well, dem nor know mi at-all. Dem bi shidren wey nor get sense and dem nor dey kwik undastand anytin. Na only bad-bad tins dem sabi do.”


So just as lion dey attack oda animals for bush, na so too dia enemies go attack dem and just as wolf bi for desert, na so too dem go distroy dem. Na leopard go dey guide di town and if anybody won kom out from di town, dem go distroy am, bikos dia sin too many and dem don turn from God.


Bikos of dis, di law dey weak and yuzles and doz wey dey judge, nor dey judge well at-all. Wiked men dey opress good pipol; dem don turn betta judgement up-side-down.


I look up again kon si two wimen dey fly kom meet us and dem get strong feada like bird own. Dem pick di basket kon fly go with am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan