Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 8:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 God sey make I ask dem, “Pesin wey fall, nor dey get up again? Abi, pesin wey miss road, nor dey turn back go pass di korrect road?

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 8:4
15 Iomraidhean Croise  

make Yu listin to dia prayers and if anybody wey dey face pain for Israel, stresh en hand pray for dis temple,


bikos no matter how many times good pipol fall; dem dey always get up again; but trobol dey distroy wiked pipol.


I don remove una sins komot like sey na tick kloud. So make una turn kom meet mi, bikos na mi bi di Pesin wey save una.”


Make wiked pipol turn from dia wiked life kon shange di way dem dey tink. Make dem turn go meet di Oga wey bi awa God, bikos E dey sorry for pesin and dey kwik forgive pipol.


But I si sey na Jerusalem profets own worse pass; dem dey sleep with who dem nor marry; dey lie; dey enkourage pipol to do bad tins, so dat dem nor go stop to live dia wiked life. To mi, all of dem bad and wiked like Sodom and Gomorrah pipol.


God sey, “If man drive en wife and di woman go marry anoda man, di man go fit go marry di woman again? Dat kind tin go make di land dirty. But Israel pipol, una bi ashawo wey get many husband and naw, una won turn back kom meet mi.


Naw, una wey nor dey faithful, make una kom back kom meet mi and I go heal una!” “Yes! Wi go kom meet Yu, bikos na Yu bi di Oga wey bi awa God.


May bi, if Judah pipol hear di way I won take distroy dem, dem go shange from all di bad-bad tins wey dem dey do, den I go forgive all dia sin and wikedness.”


God sey, “Israel pipol, if una really wont turn back kom meet mi, make una distroy all una juju,


God wey get pawa sey, “Yu tink sey I dey happy as wiked pipol dey die? No! I go like if dem turn from sin kom meet mi, so dat dem go get life.


Israel pipol, make una turn back kom meet di Oga una God, bikos una sin don make una fall.


Make una kom make wi turn go meet God! Na-im wound us, but E go heal us! Even doh E wound us, E go bandage awa sore.


Israel pipol sturbones dey work against dem. Even with evritin wey don happen, dem nor still gri turn from sin kom meet di Oga wey bi dia God.


“Israel town wey ‘neva sin wons’ don fall and e nor go fit raiz again! E just dey groun like dat and nobody gri help am.”


So my enemies, make una nor happy, bikos of mi! Bikos wen ever I fall, I go raiz-up again. Even doh I dey for darkness, Oga God go bi my lite.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan