as e dey travel go di wildaness. E go sidan under one big tree kon sey make God kill-am. E sey, “My Oga God, my eye don si wetin big pass mi, I beg, make Yu kill mi. I nor even betta pass my papa dem.”
I go gada my pipol wey remain from di kountry where I skata dem put kon bring dem kom back to dia land. Dem go get many shidren kon prosper for evritin and for evry side.
Instead dem go sey, ‘Yu bi di God wey dey alive wey bring Israel pipol kom back from di land for nort and from di oda kountries wey Yu skata dem go.’ For dat time, dem go dey dia own land.”
Yes! I sey, una go find mi and I go bring una kom back to una land. I go gada una from evry kountry and place wey I skata una go and I go bring una kom back to di land wey I from send una go Babilon. Mi, wey bi God, don tok.’
Bikos Jeremaya tell di pipol wey dey Babilon sey, dem go stay as prisonas for long time, so make dem build house, setol down, plant and chop anytin wey dem plant.’ ”
Israel God wey dey mighty sey, “Yu yorsef don si di way I take distroy Jerusalem and all di oda towns wey dey Judah. Dia town still skata and dem nor get hope again,
Na dis make mi pour my fire and vexnashon for Judah towns and all di street for Jerusalem. As e bi naw, dia life don skata and pipol wey si dem, dey fear.
Dis na wetin Oga God tell mi: “Di pipol wey remain for Israel, go bi like grape wey dem press well-well. So make yu go shek di branches again like sey na yu dey press di wine out. Den, make yu save di ones wey yu fit save naw wey time dey.”
“Awa God! Na only Yu dey do wetin dey rite, but dem dey disgrace us evriday, bikos Judah, Jerusalem and all di pipol wey Yu skata go evriwhere, nor gri listin to Yu.
But dis na wetin God dey tok, “I dey plan to distroy dis pipol and dem nor go fit eskape am. Trobol go follow dem, den dem nor go dey waka with pride again, bikos dat time go bad for dem.”
I don give una choice to choose between di blessing and di curse. Wen all dis tins don happen to una and una dey stay for di nashons where di Oga una God skata una go, una go remember di choice wey I give una.
Dem kon dey kry give di mountin and di rock sey, “Make yu fall on-top us and hide us from di Pesin wey sidan for di throne and make yu hide us from di Lamb vexnashon.”