Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 8:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Di pipol kon ask demsef, “Wetin make us just sidan for here? Make wi run go di strong towns, so dat even if wi go die, den wi go fight die for der. Since di Oga awa God don sey wi go die; E don give us poizin drink, bikos wi sin against am.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 8:14
23 Iomraidhean Croise  

So di king tell Abishai, “Sheba go give us wahala pass Absalom. So make yu take my men go fine am or e go enter some town wey dem dey guide well-well kon run from us.”


But even as I dey kwayet and nor tok wetin good or bad, my sorrow and pain still dey worse more-more.


Dem dey put poizin for my food kon give mi bad wine make I drink.


“Babilon, sidan for darkness and make yu kwayet, bikos pipol nor go koll yu kween again!


Wi don sin against Yu wey bi God; so wi dey konfess awa sins and di ones wey awa grand-grand papa dem kommit.


Den I ansa, “My God, even doh awa sins dey tok against us, make Yu kom save us bikos of di honor for yor name. True-true, wi don turn from Yu many times and sin against Yu.


So, dis na wetin mi wey bi God dey tok about Jerusalem profets: ‘I go give dem bitter food chop kon give dem wota wey dem poizin, drink, bikos dem don spread sin for di whole land.’ ”


So make wi liedan with shame! Make awa disgrace kover us. Wi and awa grand-grand papa don sin against di Oga awa God. Since wi dey yong kon rish naw, wi nor gri obey di Oga awa God.”


But wen King Nebukadnezzar for Babilon skata di land, wi sey make wi kom Jerusalem, so dat wi go fit eskape from Babilon and Siria sojas. Na dis make wi dey stay for Jerusalem naw.”


Instead, dem get strong heart kon dey woship Baal, just as dia grand-grand papa tish dem.


So, make yu listin to wetin mi, Israel God wey get pawa go do: ‘I go make dis pipol chop bitter food kon make dem drink di judgement wota wey get poizin.


Wen ever I remember as I take sofa without house to sleep, e dey pain mi like poizin for my belle.


Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok: “ ‘Among di pipol wey dey klose to mi, I go show mysef holy to dem and for where evribody dey, na der dem go for honor mi.’ ” So Aaron nor tok anytin.


Wen dia rilashons; di pipol wey go burn di dead body go kom karry di body komot from di house, dem go ask di pesin wey dey di house sey, ‘E get any oda pesin wey dey here with yu?’ Di pesin go ansa, ‘No!’ Den di rilashons go sey, ‘Kwayet! Make yu nor just menshon God name.’ ”


But Oga God dey en holy temple, so make evribody for di world, keep kwayet for en present.”


So, make evribody kwayet for God present, bikos E dey kom from en holy place.


dem kon give Jesus Christ betta wine make e drink. But wen e taste am, e nor gri drink am.


Make no man, woman, tribe or family among una leave di Oga una God kon go woship gods for oda kountries. Make nobody among una get any tree wey go bear fruit wey bitter or fit kill.


Dia vine na from Sodom and Gomorrah field. Dia grape get poizin and e bitter well-well.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan