Bikos una dey boast sey una don follow deat and dead body enter agriment. Una dey sure sey wahala nor go near una wen e kom, bikos una bilive sey una lie-lie word go save una.
Dem tell di pesin wey dey si vishon sey, “Make yu nor si any vishon for us” and dem tell di profet sey, “Make yu nor tell us di rite tin again!” Dey tell us betta and sweet tins. Make yu just dey lie give us.
Make una listin to wetin mi wey bi God tok! I hate doz profets wey dey tok dia lie-lie dreams kon lead my pipol komot from di trut. I nor send dem and dem nor dey help my pipol at-all. Mi, wey bi God don tok.”
Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?
So, I go give dia wifes to oda men kon give dia farm to oda pipol. I go do am, bikos both rish and poor pipol dey use wayo take dey get dia money. Even profets and priests don join dey deceive pipol too.