Dem sey, “Make una help and defend us from awa enemies. Make una protet us bikos dem dey always attack us. Make una nor leave us naw wey wi don run komot from dia hand.
“Make una listin to wetin mi wey bi God dey tok. Make una make sure sey dem dey always give korrect judgement for kourt. Make una protet pesin wey dem dey opress from who dey opress am and bikos of di bad tins wey una dey do, my vexnashon go burn una like fire wey nor dey kwensh.
If yu take cedar wood build house and e fine pass oda pipol own, na dat one make yu bi betta king? Yor papa enjoy life well-well, bikos e always dey good and kind, so e prosper for evritin wey e do.
Dis na wetin God tok: “Make una do wetin dey good and korrect. Make una protet pesin wey dem dey opress from who dey opress am. Make una nor trit or opress strenjas; doz wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die and make una nor kill innocent pipol for dis land.
Una must shange kon obey di Oga una God. Una must stop to live di bad life and wiked tins wey una dey do. If una stop am, God go shange en mind and E nor go distroy una.
Oga wey bi Israel God wey dey rule all of us sey, Make una shange from di kind life wey una dey live kon do di rite tin. If una shange, I go allow una stay for dis land.’
and nor gri do wiked tins or borrow pipol money to get gain. But dey keep my law and obey my kommand. E nor go die, bikos of en papa sin, but e go get long life.
Dis nor bi di same message wey God tell una thru en profets before-before wen Jerusalem and Judah town dey stay for peace and wen Negev and Judah pipol still plenty?’ ”