Dem go leave all di dead body for groun, so dat birds and wild animals go chop dem. Birds go chop dem for dry sizin and wild animals go chop dem for rainin sizin.”
My pipol attack mi like birds or hyenas and oda wiked birds dey with dem. So make all di nashons gada like wiked animals kon distroy dis pipol wey I koll my own.
And di pipol wey dis fake profets dey profesai to, na war and honga go kill dem too. Dem go trow dia dead body for evriwhere for Jerusalem street and nobody go dey to beri dem. Dis tin go happen to all of dem, dia wifes and dia shidren. I go make dem pay for all di bad-bad tins wey dem dey do.”
“ ‘Mi, wey bi God sey, “I go ponish dem for four difren ways: I go make dem die for war. I go allow dog karry dia dead body. I go allow birds and wiked animals chop dia flesh
Na wiked diziz go kill dem and nobody go mourn or beri dem. Dia dead body go full groun like manure. Na war and honga go kill dem, den bird and wiked animals go chop dia dead body.
Na for der I go for skata di plan wey Judah and Jerusalem pipol dey plan. I go make dia enemies win kon kill dem for war and birds with wiked animals go chop dia dead body.
For dat day, di pipol wey God kill, dia body go skata for difren part for di world. Nobody go mourn for dem and nobody go karry dem go beri. Dem go dey groun like manure wey dem gada.
Bikos deat don klimb pass awa windows. E don enter awa house wey dem guide well. E don kill awa shidren wey dey play for di street and di yong men wey dey di town centre.”