Before, wi sin against Yu, but naw, wi wons turn from sin kom meet Yu. Afta Yu ponish us, shame nor let us karry awa head up again. Di sin wey wi sin wen wi dey yong, dey make us dey shame.”
“So Jerusalem pipol, make una from una heart stop all di bad-bad tins wey una dey do, so dat una go dey save. Wetin make una nor fit stop to tink bad-bad tins?
So, di Oga God sey, “I go pour my vexnashon for dis land. I go pour am put for both pipol and animals body and even di trees and food wey dem plant. My vexnashon go burn like fire and nobody go fit kwensh am.”
So tell dem sey: “Dis na nashon wey nor gri obey di Oga dia God or learn from dia wahala. Nobody for der dey good and di pipol nor dey even tok about good tins again.
For Judah town and Jerusalem street, I go make sure sey nobody dey shaut or happy with joy sey pesin dey marry. Dis na bikos di whole land dey empty and dirty don full der.”
God sey, “I bin tink sey, ‘Una go really respet mi!’ Naw, make una do wetin I tok! If to sey una really gri do am, dem nor for skata una house with all dis ponishment.” But na only to sin una dey tink about.