Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 6:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Just as well dey bring fresh wota kom out, na so too Jerusalem dey bring all en wikedness kom out. I dey hear war and distroshon nois for di town kon si wound and sickness for evriwhere.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 6:7
24 Iomraidhean Croise  

Make yu dey kareful about wetin yu dey tink, bikos na wetin yu tink for yor heart, yu go do.


From una head go rish una leg, na sore full am. Una body don skata, bikos sore full evriwhere and dem nor bandage, klean or trit dem at-all.


But wiked pipol bi like sea wey dey make nois anyhow; en wave nor dey finish and na so-so dirty e dey bring.


But di evil nor go do una any good; dem dey yuzles like klot wey dem make with dirty!


Na only bad-bad tins and deat I dey profesy about. Na only curse and trobol yor message don bring kom meet mi.


God tell en pipol, “Dem nor go fit cure una wound and una sore go dey forever.


Nobody go kare for una or cure una sore; una nor get hope at-all.


Make una nor komplain about una sore again, bikos e nor get cure. I dey ponish una like dis, bikos una wikedness and sin, too mush.


E go happen bikos since dem build dis town kon rish naw, di pipol for dis town don make mi vex well-well, so I go distroy am.


Medicine nor dey Gilead again? Doctors don finish for here? If dem dey, wetin make dem neva cure my pipol?


Di vishons wey una si nor bi true and wetin una sey go happen, na lie. Una dey evil and wiked well-well and una day dey kom; di day wey God go ponish una, den di swod go kut una neck komot.


Di pipol wey e kill, na dia blood dey di town. Di pipol blood nor tosh groun where san go for fit kover am. Instead, di blood stain di rock.


God wey get pawa sey, “Una wey bi ruler for Israel, na since una dey sin! Make una stop una wahala and opreshon. Make una dey do di rite tin. Una nor go ever drive my pipol komot from dia land again. Na mi wey bi Oga una God dey tok so.


Wahala don turn swod wey go ponish wiked pipol. Nor of dia tins go remain: dia money, propaty, happiness and glory, all of dem go vanish.


So make dem prepare to shain my pipol, bikos na dead body full di land and na wahala full di town.


Bad tins go happen to Jerusalem pipol, bikos dem don spoil di town kon turn am to where wayo full.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan