6 Dis na wetin Oga God wey dey mighty tok, “Make una kut all di trees for Jerusalem trowey kon build wall round am. I must ponish dis town, bikos opreshon full am.
So dis na wetin God tok about Assyria king: ‘E nor go enter dis town or shot one arrow against am. No soja wey karry shield go kom near di town and dem nor go build anytin take surround am.
Si as Babilon pipol build dia kamp round di town and dem won seize and attack am. Dem go win, bikos war, honga and diziz don already dey kill yor pipol. Naw, make Yu si sey evritin wey Yu tok, don dey happen.
Den Siria king go katch and take one strong town. Di sojas wey dey Egypt nor go fight again; even di best sojas wey dey with dem nor go get pawa again.