Naw, make una tink am well! Man fit get belle kon born pikin? So wetin make una men dey put dia hand for belle like sey dem bi woman wey won born? Wetin make evribody dey fear?
I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”
I fear well-well wen I hear all dis tins and my lips kon dey shake. Fear and kold katch mi at wons. I go really wait for di time wen God go ponish doz wey dey attack us.
Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.