I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”
Wetin I go fit tok? Who don ever si dis kind sofa before? Wetin I go fit take kompare yu, Jerusalem? How I go fit take konfort yu? Bikos di wound wey yu wound, deep like sea. Na who go fit heal yu?
Pipol wey dey chop betta food before, don turn who dey beg food for street. Pipol wey dey wear fine and betta klot before, don turn who dey wear rag naw.
Di woman wey dey kwayet and gentol among una, wey nor go even put en leg for groun, bikos of how e fine rish, go turn kon attack en husband and shidren