Dis message na about Edom pipol. Somebody koll mi from Edom land sey, “Yu wey dey guide, na wen day go break? Na wetin remain for di nite? Make yu tell mi wen all dis tins go end.”
E sey, “All di leaders wey suppose warn my pipol, dey blind! Dem nor know anytin. Dem bi like dog wey nor dey bark; dem just liedan dey dream. Make una si as dem like sleep well-well!
Jerusalem pipol, I go put pipol wey go dey guide una walls and dem nor go kwayet both for day and nite. But una wey dey pray give God, make una nor stop at-all.
So tell dem sey: “Dis na nashon wey nor gri obey di Oga dia God or learn from dia wahala. Nobody for der dey good and di pipol nor dey even tok about good tins again.
Make una nor bi like una grand-grand papa dem. Before-before, my profets prish give dem sey, make dem stop to sin and do evil, but dem nor gri listin or obey dem.
Make una obey una leaders and do evritin wey dem tok, bikos na dem dey kare for una soul and dem go ansa God wen E ask dem how dem do dia work. Make una let dem do am with happiness, nor bi with komplain, bikos una nor go get any betta tin from am.