Jeremaya 6:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
10 So I ansa, “If I go warn and tok to dem, na who go gri listin? Dia ear block, so dem nor go hear mi, bikos God word dey make dem vex well-well and dem nor like am at-all.
Make una keep di kovenant wey una make with mi wey bi una God kon dedikate unasef to mi. If una nor do am and una kontinue di bad tins wey una dey do, my vexnashon go burn una like fire. E go burn well-well and nobody go fit kwensh am.”
I go ponish Egypt, Judah, Edom, Ammon, Moab and di pipol for desert wey kut dia hair short for di temple. Even for Israel, nobody wey dem sekonsaiz, keep my kovenant for en heart.”
Amazaya wey bi priest for Bethel kon send message go give King Jeroboam for Israel sey: “Among all di pipol, na Amos dey plan against yu and di land nor go fit bear all wetin e dey tok.
But wen e si many Farisee and Sadusi pipol dey kom make e baptize dem, e kon tell dem, “Una, snake shidren! Who warn una about God judgement wey dey kom?
Bikos time dey kom wen pipol nor go won hear good and betta tishing again. Instead, dem go dey follow wetin dey hongry dem to do kon dey find tisha wey go tish dem wetin dem won hear.
Na faith make Noah build ark afta God warn am about wetin go happen. E obey wetin God tok and na di ark save en and en family. Na di same faith Noah take kondemn di world, kon inherit di raitiousness wey dey kom.