Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 6:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Benjamin pipol, make una run for una life! Make una run komot from Jerusalem! Make una blow trumpet for Tekoa kon put sign for Bet-Hakkerem, bikos wahala and distroshon dey kom from nort.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 6:1
19 Iomraidhean Croise  

so e send for one wise woman for Tekoa. Wen di woman kom, Joab tell am, “Make yu do like sey yu dey mourn; wear mourning klot kon skata yor hair. Make yu bihave like woman wey don dey mourn since.


Na Malkijah wey bi Rekab pikin, wey bi ruler for Bet-Hakkerem aria, ripair di Dirty Gate. E ribuild am kon fix di doors, en bolts and bars.


Tekoa men do di next part wey dem give dem, but some among di leaders for di town nor gri do di work wey dia oga give dem to do.


So make una listin! One news dey kom naw! Wahala dey kom from di nashons for nort! Dia sojas don skata and turn Judah town to desert where animals dey stay.


‘I go koll di pipol wey dey nort and my savant King Nebukadnezzar for Babilon and dem go kom fight against Judah pipol and di towns wey dey round Jerusalem. I go distroy and skata dis nashon and di ones wey dey round am, forever. I go make pipol si and dey fear dem.


Evribody for di land go run wen dem hear di shariot sound kon si sojas with dia bow and arrow. Some go run go hide for forest; odas go klimb mountin go hide for rocks. Di towns go empty and nobody go remain for der again.


“God sey, ‘Si, sojas dey kom from one land for nort; one nashon wey dey far and dem dey ready to kom fight.


Na one shepad from Tekoa wey en name bi Amos, tok dis word. Two years before di eart shake kon distroy tins, wen Uzzaya bi king for Judah and Jehoash pikin, Jeroboam dey rule Israel, God kon show Amos dis tins about Israel.


Pipol nor dey fear, if dem blow war trumpet for di town? Abi wahala dey just happen for town, wen God nor allow am?


Di shariot wey di black horse dey drag, dey go nort; di white horse dey go west and di horse wey get spots dey go di kountries for sout.


Judah men nor fit win all Jebus pipol wey dey stay Jerusalem, so Jebus pipol still dey stay with Judah pipol till today.


Benjamin tribe nor fit porshu Jebus pipol komot Jerusalem finish, so till today, Jebus pipol still dey stay for Jerusalem with Benjamin pipol.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan