Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Jeremaya 52:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Dem take am go meet Babilon king for Riblah for Hamat land. Den Babilon king judge am for der.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Jeremaya 52:9
15 Iomraidhean Croise  

For di temple, Solomon and all Israel pipol kon celebrate Shelta Feast for fourteen days. Many pipol kom from Hamat Road wey far well-well for nort and from Egypt borda for sout.


Fero Neko katch am put for prison for Riblah wey dey Hamat land, so dat e nor go fit rule Jerusalem pipol. Neko sey make di pipol for di land pay am 7,500 pound for silva and 75 pound for gold.


Dem katch di king kon karry am go meet King Nebukadnezzar for Riblah, where e for judge en matter.


So God kon allow di oga for Assyria sojas attack Judah. Dem seize Manasseh, hook en nose, tie am with bronze shains kon karry am go Babilon.


E go Hamat-Zoba kon seize am.


Naw, mi, God promise sey, “King Zedekaya with en ofisas and doz wey survive di war, di honga and diziz, I go give dem to King Nebukadnezzar for Babilon and to dia enemies wey won kill dem. King Nebukadnezzar go kill dem with swod and e nor go pity or sorry for dem at-all.” ’ ”


But Babilon sojas porshu dem kon katch Zedekaya near Jeriko. Den dem take am go meet King Nebukadnezzar for Riblah town wey dey Hamat land and na for der Nebukadnezzar for judge am.


Dem katch di pesin wey make us dey alive, di king wey God choose and wi bin get hope sey e go protet us from awa enemies.


and una go die wen una dey fight war for una kountry. Den evribody go know sey na mi bi God.


Dem go attack yu from nort with many sojas and shariot. Dem wear shield and helmet for head and dem go gada round yu. I go give yu to dem and dem go judge yu with dia own law.


So dem kon go shek di land from Zin and Rehob Wildaness, where dem dey pass enter Lebo-Hamat.


Di borda go from Shefam go Riblah for di east side for Ain and for Chinneret Sea.


Gebal pipol aria and evriwhere for Lebanon for di east. From Baal-Gad; bottom Mount Hermon go rish Lebo-Hamat.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan