Den Fero sey make dem go koll Josef kom. So dem take Josef kwik-kwik komot from di prison kon shave en hair and shange en klot, den dem take am go meet Fero.
David tell am, “Make yu nor fear. I go dey kind to yu, bikos of Jonatan wey bi yor papa. I go give yu evritin wey bi Saul, yor grand-papa own and anytime wey yu kom my tabol, I go welkom yu.”
Den di angel tell doz wey stand near am, “Make una pul di dirty klot wey dis man wear so, komot from en body.” Den e tell Joshua, “I don forgive yu all yor sins and naw, I go give yu new klot make yu wear.”