Dis na di pipol wey from Babilon go back to Jerusalem and Judah. And each of dem go back to en town. Dia family dey Babilon since King Nebukadnezzar take dem go der as prisonas.
Dis na di pipol for di aria wey kom back from Babilon since King Nebukadnezzar karry dem go der as prisonas. Dem go back to dia towns for Jerusalem and Judah.
Jerusalem enemies don turn dia oga naw and dem dey prosper, bikos God ponish Jerusalem pipol for di sins wey dem kommit. Dem don katch and take dia shidren go far land.