Jeremaya 52:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
24 Nebuzaradan wey bi di ofisas oga, take Seraya wey bi di High Priest, Zefanaya wey bi di sekond priest with three shief wey dey keep di gate kon karry dem go as prisonas.
Di king kon orda Hilkaya wey bi di High Priest, di priest wey follow am and di guards sey, evritin wey dem take dey woship Baal and Asherah juju and all di stars wey dey God Temple, make dem bring am kom out. Di king burn dem outside Jerusalem for Kidron Valley kon karry dia ashes go Bethel.
Afta all dis tins don happen, for di time wen King Atazazes dey rule Persia, one man wey en name na Ezra kon kom from Babilon. E trace en grand-grand papa family kon know sey e kom from Aaron, di High Priest family. Ezra na Seraya pikin and na Zabud wey Hilkaya born, bi Seraya papa.
Only one day for yor house betta pass one tazon years for anoda place! E betta make I bi gateman for God house dan to dey enjoy life for wiked pipol house.
God sey, ‘I go make yu dey fear yorsef and yor friends go dey fear yu too. Yu go dey si as dia enemies go kill dem finish. I go make Judah pipol serve Babilon king and e go take some of dem go en kountry as slave kon kill di odas.
King Zedekaya send Pashhur wey Malkijah born and Zefanaya, di priest wey bi Maaseaya pikin, go meet Jeremaya, but God don tell Jeremaya before dem rish der. Zedekaya sey make dem tell Jeremaya sey,
sey di Oga wey bi Israel God wey dey rule di nashons get message for am. Tell am sey, ‘Just as yor mind tell yu, na so too yu send leta go give Zefanaya di priest wey Maaseaya born; di oda priests and all di pipol wey dey Jerusalem.’ For yor leta, yu tell Zefanaya sey,
enter di temple. I take dem enter di room where Igdalaya pikin, Profet Hanan disciples dey stay. Di room dey near where di offisa for di temple dey stay and Maaseaya wey Shallum born, wey dey guide di temple, dey stay for di room wey dey up, inside di temple.
So King Zedekaya send Jehucal wey Shelemaya born and Priest Zefanaya wey bi Maaseaya pikin sey make dem kom tell mi make I pray make God kom help awa pipol.
For di tent day for di fift mont for di nineteent year wey King Nebukadnezzar don dey rule, Nebuzaradan wey bi di king advise and dey kommand di sojas, enter Jerusalem.
Den Nebuzaradan karry di pipol wey remain for di town go Babilon as slave. Di pipol wey remain for di town, na di kraftmen and doz wey ready to serve Babilon king.
So dis na wetin mi God dey tell una. ‘I gri sey di town na pot and na pipol wey una kill bi di meat! So, una nor go stay here again, bikos I go remove una from di town!
Mi wey bi God wey get pawa dey sey I bi una enemy. I go take my sheep from una hand and una nor go bi dia shepad again; I nor go let una kare for unasef again. I go save my sheep from una and una nor go chop dem again.