Di cups, lamp tins, bowls, plate for incense and di pans wey dem take dey karry shako; di Most Holy Place door handle and di doors wey dey outside di temple. Na gold dem take make all dis tins.
Na pure gold dem take make di wick iron, di bowl, spoon and di censer. Na gold dem still take make di door-mot, di house front, inside di door and di temple door.
Den all di tools wey dem dey use take work for di altar, dem go put am on-top: di tray, di hook, shovel and basin. Den dem go kover am with fine leda kon put di poles wey dem go take karry am for inside.
“Make dem use blue klot kover di tabol wey God bread dey, di plate, di incense bowl, di ofrin bowl and di jar wey dem dey use for wine ofrin. Bread must always dey di tabol.