16 But e leave some poor pipol for Judah make dem kare for di vineyards and farms.
But e leave di poor pipol for di land kon give dem field where dem go plant food.
For di sevent day for di fift mont and di nineteent year wey King Nebukadnezzar dey rule, Nebuzaradan, wey bi Babilon sojas oga kon enter Jerusalem.
Di sojas oga take mi go one side kon tell mi, “Di Oga wey bi yor God sey, E go distroy dis land
“Man pikin, di pipol wey dey stay di empty town for Israel dey sey: ‘Abraham na just one man and dem gi-am di whole land. So naw wey wi many well-well, na wi get di land too.’